National

States Arrange Bush Police To Chase Bandits Out Of Bush

todayJune 8, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Oboi unto security marra, like dis now bush men don mout naija forest, naim oyobo dey call forest guard, say war don start against jaguda boys for di bushes Kebbi, Gombe, Kwara, and other states.

You sabi, baba Presido, Bola Tinubu, bin give green light make dem recruit 1,000 forest guards because of the plenty kidnapping and bandit attack wey hapun for Oyo and Kwara States.

Na dis state carry for head dey do, for Kebbi State, 819 forest guards don mount area for Kalgo, and dem don send dem to different local for Kebbi state.

Di Kebbi Deputy Govo, Umar Tafida, sti beg traditional rulers and communities make dem help di security pipo with solid information so dat peace go return.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds