National

Suicide Bomber Kill 5, Injure 35 For Ngamboru Market Mosque, Maiduguri

todayDecember 25, 2025 10

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Five people don kpai and 35 odas don get different kain injury afta one teen suicide bomber blow imself for mosque inside Ngamboru market, Maiduguri, during evening prayers on Wednesday.

Eyewitness talk say di blast happen around 6:10pm when plenty traders dey worship before dem go house, and e make fire plus thick smoke burst for mosque ceiling.

Di explosion scarra wetin nor good for di crowded market as people begin run for safety.

Borno state police PPRO, Nahum Kenneth Daso, confirm say dem don carry di once wey wunjor  go University of Maiduguri Teaching Hospital and oda hospitals for town.

 

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app