By: Rilwan Agbomeji
Five people don kpai and 35 odas don get different kain injury afta one teen suicide bomber blow imself for mosque inside Ngamboru market, Maiduguri, during evening prayers on Wednesday.
Eyewitness talk say di blast happen around 6:10pm when plenty traders dey worship before dem go house, and e make fire plus thick smoke burst for mosque ceiling.
Di explosion scarra wetin nor good for di crowded market as people begin run for safety.
Borno state police PPRO, Nahum Kenneth Daso, confirm say dem don carry di once wey wunjor  go University of Maiduguri Teaching Hospital and oda hospitals for town.