Sports

Super Eagles, Officials Don Vex, Boycott Training Over Unpaid Allowances

todayNovember 12, 2025 3

Background
share close

Wahala bust for Super Eagles camp for Rabat, Morocco yesterday as players and officials refuse train because dem never see dia allowances wey don pile up since 2019. Di Eagles dey camp for The Rive Hotel ahead of dia 2026 World Cup playoff against Gabon wey go happen tomorrow. Dem players wey reach camp between Sunday and Monday don do first training on Monday evening, but when e reach yesterday evening, dem lock up say dem no go enter pitch again until NFF pay all di money wey dem owe dem. For one unsigned statement wey reach The Guardian, di players talk say, “Di full squad including officials boycott training today for Morocco because of di wahala wey still dey with unpaid bonuses. We dey wait for quick solution so we fit continue prepare for Thursday game against Gabon.” Dem also remind say di money wey NFF dey owe reach back to 2019 AFCON, and dem don tire for di disrespect from di federation.

According to di players, di current NFF board dey claim say dem no get hand for 2019 bonuses because dem no dey in charge that time. Dem still para say nobody for Super Eagles don collect dia allowance or bonus for qualifying reach 2025 AFCON and di 2026 World Cup playoff. One source close to di players yarn say dem no happy with how NFF dey handle di World Cup qualification matter, but dem still dey play because dem wan reach di World Cup by all means. “Dem reason say if dem no collect dia money now and qualification no happen, di money go vanish,” di source add. Efforts to reach NFF President Ibrahim Gusau and Secretary General Mohammed Sanusi no work as dem dey travel go Morocco, while di Media Director, Ademola Olajire, no pick call or respond to message.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app