By: Esther Ayoola
Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday.
Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief.
Washington sef confamate say, di jaguda boy na Islamic State militant, and e kpai after di attack, wey dem call terrorist attack.
Syrian authorities add say dem don arrest 11 security officers for make dem con tuk wetin dem sabi about di incident.