Adamawa ADC Suspend Atiku, Babachir Lawal, Others Say Dem Dey Cause Division
By: Esther Ayoola One faction chairmo for Adamawa state Africa democratic Congress, ADC, Raji Zumo, don announce say dem don suspend former Vice President Atiku Abubakar. Dem make di announcement for press conference wey hapun on Monday. Di ADC faction chairmo, also suspend former SGF Babachir Lawal and party transition committee chairmo, Sadiq Ibrahim. According to am, di reason be say dem dey cause division for di party.