AFCON 2025

10 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Super Eagles Buy Waka Marrakesh For AFCON Quarterfinal

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation don confamate say Super Eagles go comot Fez go Marrakesh on Thursday as dem dey prepare for Africa Cup of Nations quarterfinal. Dem go face Algeria for match on Saturday by 5pm. According NFF post on X, say All 26 available players join training on Tuesday evening for Sardienne Complex. Defender Ryan Alebiosu still dey sidelined as e dey recover from injury.

todayJanuary 7, 2026 3 2

Sports

Coach Gamondi Say Tanzania Sabi Ball Pass Nigeria

By: Rilwan Agbomeji Tanzania coach Miguel Gamondi talk say e still dey happy small with how im team play, even though dem lose 2–1 to Nigeria for AFCON match on Tuesday. Na Nigeria score first through Semi Ajayi, before Charles M’mombwa equalise for Tanzania early second half. But celebration no last as Ademola Lookman quickly score winner give super eagles, while Tanzania still dey find dia first AFCON win.   […]

todayDecember 25, 2025 17

Sports

AFCON 2025 – Simon Sure Say Super Eagles Go Beat Tunisia

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles winger, Moses Simon don talk say Naija go fight hard make dem collect full points against Tunisia for AFCON 2025. Di match go happen Saturday for Complexe de Fès for Morocco, as both teams dey eye anoda win. Simon say team dey confident and ready to overcome Tunisia, wey dem dey call Carthage Eagles. Nigeria and Tunisia don start di tournament with win, and dis […]

todayDecember 24, 2025 8

Sports

Tanzania Eyes First Ever Afcon Win Say Na Nigeria Dem Wan Take Start

By: Esther Ayoola Tanzania cochie, Miguel Gamondi,  ni bring mata dis morning on say if  dem fit finally get dia first victory when dem play Nigeria for 2025 AFCON for Morocco on Tuesday, e go belike say na world cup dem win. Di taifa stars don play three AFCON tournaments—1980, 2019, and 2023—and dem never win any of dia nine matches, so dis group C opener go be dia 10th […]

todayDecember 23, 2025 4

Sports

Morocco Start AFCON Strong, Beat Comoros 2-0

By: Esther Ayoola Morocco don start dia Africa Cup of Nations waka wella beating Comoros 2-0 for di tournament opener on Sunday. Brahim Diaz score di first goal 10 minutes afta di second half start, and Ayoub El Kaabi follow am up with fine overhead kick. Dis win don give di Atlas Lions better chance for di next Group A matches against Mali and Zambia.

todayDecember 22, 2025 4

Sports

Super Eagles Go Camp For Egypt For AFCON 2025

Super Eagles go set up training camp for Egypt next month to prepare for di 2025 Africa Cup of Nations, SCORENigeria report. Di camp go open on Wednesday, 10 December, and di three-time African champions go play friendly match against di Pharaohs of Egypt four days later. Di friendly na part of di team build-up for AFCON 2025 finals, and head coach Éric Chelle dey expected to submit final list […]

todayNovember 28, 2025 15

Sports

Fredrick Go Miss AFCON 2025 Due To Injury

Super Eagles defender Benjamin Fredrick don set to miss 2025 Africa Cup of Nations with knee injury, according to reports. Di young star knack di injury during training for Belgian Pro League club Dender last week Friday. Di 20-year-old wey impress for im debut against Reggae Boys of Jamaica in May don become key player for Eric Chelle, starting di Super Eagles last six games. Di versatile defender even miss […]

todayNovember 26, 2025 6

Sports

AFCON 2025 – Nigerian Officials MIA As CAF Release Full Officiating Team

Confederation of African Football (CAF) don release di full list of referees and video assistant referees (VAR) for di 2025 Africa Cup of Nations, but no Nigerian dey included for di list. CAF put 28 centre referees and 14 VAR officials, with host nation Morocco, Algeria, Egypt and Mauritania providing two centre referees each. Some of di VAR officials wey go Morocco include Algeria’s Lahlou Benbraham, Egypt’s Mahmoud Ashour, Tunisia’s […]

todayNovember 26, 2025 10

Sports

Chelle Summon Abuja As Nigeria Rush Team Reshuffle Before AFCON

No be small matter as Nigeria Football Federation (NFF) don start plan to reshuffle Super Eagles squad ahead of 2025 Africa Cup of Nations (AFCON), as top officials talk say na only players wey dey perform well for dia clubs and dey committed go fit make di team. One senior NFF official wey yarn on Thursday talk say urgent reforms don dey necessary after di team recent failures, including wey […]

todayNovember 24, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app