Super Falcons Climb FIFA Ranking, Sti Reigning As Africa Number One
By: Esther Ayoola Naija Super Falcons don climb one step go 36th position for latest FIFA Women ranking, and dem sti be number one for Africa. Dis new ranking wey dem release on Tuesday show small improvement from where dem dey before for December 2025. Di update come afta two friendly matches wey dem play against Cameroon, where dem first lose 1–0 for February before dem bounce back win 3–1 […]