obodo oyinbo

Paraguay Presido Resign Because of Bank Wahala

todayNovember 6, 2026 4

Background
share close

Paraguay Presido, Santiago Peña, don announce say e wan resign  after di bank wey join with am collapse. E tok dis wan on on Thursday, November 5, 2026.

Di wahala start when di bank collapse, and dia Central Bank lock am up, so about three million customers no fit touch dia money again.

Di bank dey keep money for old people pension and some Gornment work too, na so pipo vex come out for street to protest.

As di matter dey hot, lawmakers point finger give Peña because e get shares for di company wey own di bank before before, until last year.

Dem point finger give am am say e get hand for di bank matter and say e use im position anyhow, but Peña no gree say e do anything wrong.

For video wey e put for social media, e beg di pipo make dem forgive am if e don fail dem, and say e no mean to betray di trust wey dem give am.

Di lower house don vote make dem carry Peña go face impeachment, but e say e go show face for Senate on Friday, November 6, to defend imself.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds