Presido Tinubu Cancel Ogun Trip, Waka Go Jos On Top Insecurity Marras
Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don cancel im Ogun trip wey suppose happen on Wednesday, make im first waka go Jos, Plateau State, to feel with victims of di gbege wey kpai at least 27 pipo for Angwan Rukuba district on Sunday. Na Special Adviser to di Presido on Informate and Strategy, Bayo Onanuga, talk am for statement wey im sign on Wednesday. Di move come after Tinubu and Plateau State […]