CHELSEA

10 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

BBC Sport Rate Premier League Teams After Five Games

By: Mariam Ajayi Premier League don enter im first international break for 2026/27 season after teams don play five matches with different performances. Brighton get rating of nine out of ten after dem score 16 goals for five matches, while Brentford get eight out of ten and remain unbeaten. Arsenal get seven out of ten, while Aston Villa, Bournemouth and Chelsea get six out of ten as dem still get […]

todaySeptember 21, 2026 15

Sports

Chelsea Wan Sign Atalanta Young Defender Honest Ahanor

By:  Mariam Ajayi Chelsea dey in talk to sign Atalanta defender, Honest Ahanor, with di Italian club ready to sell di  highly-rated 18-year-old if Chelsea fit meet dia €40m (£34.3m) price. According  to report, Chelsea first show interest in Ahanor when dem dey negotiate di signing of Atalanta right-back Marco Palestra for July. Ahanor, wey mainly dey play left-back, join Atalanta from Genoa last summer for around €16m, with another […]

todayAugust 27, 2026 19

Sports

Man City Prepare £120m for Chelsea Star Enzo Fernandez

By : Mariam Ajayi Manchester City dey prepare fresh bid for Chelsea midfielder Enzo Fernandez as Premier League champions dey push to sign di Argentina international before transfer window close. Reports say City don make Fernandez priority target as coach Enzo Maresca dey look to strengthen Chelsea midfield after several major departures. Chelsea value di 25-year-old midfielder at £120 million and dem fit consider sale only if dem secure suitable […]

todayAugust 26, 2026 17

Sports

Chelsea Clear  Enzo Fernandez Say E Go  Anywhere

By: Mariam Ajayi Chelsea coachie  Xabi Alonso don drop micro soft update say Enzo Fernandez  nor dey for sale.   Aproko pipo bin dey tuk say Manchester City reportedly dey interested in di 25-year-old player Untop transfer update today, na Di Coachie everything how the club dey very happy to keep, dat Enzo Fernandez na sweetheart.  

todayAugust 21, 2026 11

Sports

Xabi Alonso Start Chelsea Job With 6-4 Win Against Western Sydney

By: Esther Daniel Chelsea manager Xabi Alonso don begin him reign with victory after Chelsea beat Western Sydney Wanderers 6-4 for one dramatic pre-season match on Tuesday. Brazilian striker Joao Pedro na di hero of di game as he score three goals within nine minutes to help Chelsea secure di win. Di former Real Madrid coach, wey take over on July 1, use plenty young players for di match because […]

todayJuly 28, 2026 17

Sports

Manchester United to sign Chelsea Midfielder Andrey Santos 50 million

By Oluwatosin Ibrahim Manchester United and Chelsea don do two aside agree deal for brazil young midfielder Andrey Santos. Say, United go first pay £48 million, while another £2 million go come later if e meet some conditions. Chelsea also go collect 10 percent if Manchester United sell Santos in future. Santos don get permission to do his medical before the transfer complete

todayJuly 9, 2026 20

Sports

Chelsea, Man City Drag Over Maresca Deal For Guardiola Job

By: Esther Ayoola Chelsea and Manchester City negotiations for Enzo Maresca to replace Pep Guardiola don enter go slow because of compensation mata. Guardiola don already announce say im go leave City afta many successful years, and City want Maresca take over. But Chelsea dey insist say dem suppose pay money because Maresca sti get contract with dem before he comot Stamford Bridge. As things stand, both clubs sti dey […]

todayJune 9, 2026 25 4

Sports

Chelsea Suspend Enzo Fernandez Say Im Break Club Rules

Say like dis na, Enzo Fernandez no go play for Chelsea for di next two matches after im talk about im future. Dis na according to update by coachie Liam Rosenior for im pre match conference. According to Rosenoir, di club get ruled and Enzo don pass di line as make comment say im wan join Real Madrid. Di 25-year-old Argentine wey join Chelsea January 2023 for record £107 million, […]

todayApril 3, 2026 37

Sports

No Write Note Giv Chelsea Players – Emmanuel Petit

France legend Emmanuel Petit don clear Chelsea manager Liam Rosenior to stop passing note to players. Petit tuk dis one during im chat with Talksport, after Chelsea lose 3-0 to Everton for Premier League. E tuk say Rosenior dey shame imself with di paper, because players no be children, dem no need all dis kind writing. Petit explain say whenever Rosenior try show substitution note to players wey dey come […]

todayMarch 24, 2026 29

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds