One Kenyan man, Ali Kololo, wey dem wrongly sentence to death over di 2011 attack on one British couple, don accuse London Metropolitan Police of spoiling im life.
Dem arrest am after Somali gunmen kill David Tebbutt and kidnap im wife, Judith, for one beach resort for Kenya.
Police investigation help make court sentence Kololo to death for 2013, but dem later cancel di sentence after e don spend more than 10 years for prison.
Kololo now dey sue di UK police, say one former senior detective use false information against am for court. Di police dey challenge im demand for compensation, as Kololo say di prison matter don scatter im life and family.