Police Explain Wetin kpai DCP Khan Salihu
Lagos State Police Command don clear air say story wey bin dey fly say late DCP Khan Salihu dem kidnap before im kpai na fat lie from di pit of hell. Police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi, explain for statement, say di officer just complain say e no dey well, dem rush am go hospital, naim doctor konfam say e don kpai. Police tuk say di report na fake news […]