Iran don put one big billboard and plenty banners for Tehran, wey carry threat to kill US Presido Donald Trump on Tuesday, as dem dey increase dia threat against di American leader.
“We go kill Trump,” na wetin di big billboard for Enghelab Square for Tehran tok.
Di billboard show Trump inside prison, with im head down.
Dis one dey happen as Iran and US dey try find way to sit down for negotiation table to stop di war from start again.
Di war don spread reach different parts of di region and make prices rise for different parts of di world.
Tehran accuse Trump say e purposely bomb civilian areas during di war, including school and wedding ceremony, wey kpai plenty pipu, including women and pikin dem.
Meanwhile, Trump wey dey face important midterm election for America on Tuesday, as voters no too happy with di way di Iran war dey go, don tok say agreement between America and Iran fit happen.