football news

10 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Ayyoub Bouaddi Hint Say E Go Play Defensive Midfield Role For Man City

BY: Blessing Aminu Ayyoub Bouaddi don hint say e go play as defensive midfielder for Manchester City after e complete record-breaking £86 million move from Lille. Di 18-year-old don become di most expensive teenager wey ever sign for Premier League, as City bring am in from French club Lille. Bouaddi say e be team player wey dey always try put im teammates for better position and give everything for di […]

todayAugust 26, 2026 16

Sports

Maresca Confess Say  Man City Na  Still  Work In Progress

By: Mariam Ajayi Manchester City coach Enzo Maresca don talk down di team chances of winning di Premier League title dis season, despite dia dramatic 2-1 comeback win against Bournemouth. City struggle for most of di match before late goal from Marc Guéhi and Joško Gvardiol turn di game around and give dem all three point. Maresca say di team still be work in progress, as e dey test different […]

todayAugust 24, 2026 9

Sports

Xabi Alonso Start Chelsea Job With 6-4 Win Against Western Sydney

By: Esther Daniel Chelsea manager Xabi Alonso don begin him reign with victory after Chelsea beat Western Sydney Wanderers 6-4 for one dramatic pre-season match on Tuesday. Brazilian striker Joao Pedro na di hero of di game as he score three goals within nine minutes to help Chelsea secure di win. Di former Real Madrid coach, wey take over on July 1, use plenty young players for di match because […]

todayJuly 28, 2026 12

Uncategorized

Rudi Garcia Vow To Shock Spain For World Cup Quarter-Final!

By : Jolayemi Olajide Belgium coach Rudi Garcia yarn for Los Angeles on Thursday say dem dey ready to shock Spain for dis Friday quarter-final game. Him talk say dem get full belief to win because dem come ready to give Spain heavy vawulence despite wetin people dey think. The team show say dem dey standard after dem wire USA 4-1 during the round-of-16 stage to qualify for dis level. […]

todayJuly 10, 2026 10

Sport Yarns

Argentina, France Set for Big World Cup Clash Against Austria and Iraq Tonight

By : Jolayemi Olajide Unto di World cup update, Argentina dey face Austria for dia World Cup Group J match today by 6 p.m. Nigerian time. While France go also meet Iraq for Group I clash by 10 p.m. Nigerian time, with Kylian Mbappé and im teammates ready to push for another victory. Both matches go be big test as teams dey try secure beta position for dia group stage […]

todayJune 22, 2026 13

Sport Yarns

Chelle Drop Super Eagles List As New Players Join Unity Cup Battle

By : Jolayemi Olajide Super Eagles coachie, Éric Chelle don release squad for Unity Cup plus international friendly matches against Poland and Portugal. Team captain Wilfred Ndidi, Francis Uzoho, Moses Simon and Terem Moffi dey among di players wey make di list. New players like Arthur Okonkwo, Raphael Onyedika and Rafiu Durosinmi sef get first invitation to join di team. Nigeria go face Zimbabwe national football team for Unity Cup […]

todayMay 20, 2026 21

Sport Yarns

Southampton Collect Ban Say Dem Spy Opponent Training Sessions

By: Esther Ayoola Southampton FC don collect punishment say dem dey spy dia opponent before match. According to independent disciplinary commission, Southampton watch training of Oxford United FC and Ipswich Town FC, and even film Middlesbrough FC before play-off semi-final. So like dis Middlesbrough go take Southampton place for championship playoff final and dem deduct dem 4 point from next season.

todayMay 20, 2026 15

Sport Yarns

Aston Villa Wipe Forest 4-0, Enter First European Final In 44 Years

By: Jolayemi Olajide Aston Villa don qualify for dia first European final in 44 years, beating Nottingham Forest 4-0 for dia Europa League semi-final second leg on Thursday. Dem overturn di 1-0 first leg loss as Ollie Watkins score before half-time, while Emiliano Buendia add another one through penalty after di break. Captain John McGinn finish di job with two late goals to seal di win for Villa wey end […]

todayMay 8, 2026 20

Sports

Nigeria Football Federation (NFF) don announce 36-player squad for Flamingos ahead of their second-round qualifier for FIFA U-17 Women’s World Cup for Morocco. New head coach Akeem Busari pick five goalkeepers, 10 defenders, 13 midfielders and eight forwards as dem begin preparation for important tie against either Niger Republic or Guinea. Di two countries go first meet for first round, and winner go come face Nigeria. Niger Republic go host […]

todayApril 11, 2026 24

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds