Four Die as Iranian Army Helicopter Crash For Market inside Isfahan
By: Esther Ayoola Four people don kpai afta one Iranian Army helicopter crash for fruit market on Tuesday morning for Khomeynishahr, Isfahan province. According to state news agency IRNA, di pilot, co-pilot and two fruit sellers wey dey ground lose their life for di askident. Dem say na technical problem cause di helicopter to fall enter di busy market area. Dis crash na one of several air askidents wey don […]