By: Esther Ayoola
Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don yarn update, say oga presido, Bola Tinubu dey happy, as Lagos dey plan to set up Lagos International Financial Centre (LIFC).
Sanwo-Olu yarn dis one for statement wey govo media tuk tuk, Gboyega Akosile sign on Monday.
Say di di training na Lagos International Financial Centre organize am, TheCityUK run am, and UK government fund am.
Sanwo-Olu say LIFC no be for one person or region, e dey for Nigerians to package Naija to di world.