Kogi Confirm Say Dem Don Kill Bandit Wey Attack School
Kogi State Gofment don confirm say security operatives do Rambo doings kpai one notorious bandit leader, Kachala Ibrahim Batijo, wey dem say na im plan recent attack for one school for Iluke Bunu, Kabba/Bunu LGA. State Commissioner for Information and Communications, Kingsley Fanwo, tok dis one on Tuesday for Tv sit down tuk, say Batijo die during joint security operation alongside oda bandits. According to am, na di same bandit […]