LAGOS POLICE

27 Results / Page 1 of 3

Background

Lagos

Lagos Police say di tear-gas picture of pensioners for alausa na AI

By: Ayobami Dada Lagos Police don deny report say dem fire tear gas on pensioners during dia protest for Alausa on Monday, August 31. Police say about 500 pensioners gather peacefully, while security operatives dey maintain order, dem no fire any tear gas. Di Command say after government officials address di protesters, NUP executives hold meeting before dem peacefully comot around 4:30pm. Police also yarn say di viral photo wey […]

todaySeptember 1, 2026 1

Entertainment

UAG Demands New Team For Mohbad Investigation

By: Yusuf Abuh United Advocates Group, UAG, don ask Lagos Police Commissioner Fatai Tijani to form new team to investigate Mohbad death, say e go make di probe transparent. UAG legal adviser Oluwatosin Afolabi make di call for statement as concern grow over delay in di investigation. Di group say fresh probe start April 2025 but e never reach conclusion since dem transfer am to Lagos Police Command. UAG say […]

todayAugust 25, 2026 12

Lagos

Lagos Police Hunt Two Men Say Dem Allegedly Kpai One Woman For Ikoyi

By:Yusuf Abuh Lagos State Police Command don launch manhunt for two men, Folawiyo Alagbado and Ajibola Obateru, say dem allegedly go kpai kpai person mama for Ikoyi area of Lagos. Police tok dis one for wanted-person bulletins wey dem post for di command X handle on Wednesday. According to police tuk tuk, Adebisi Abinbola, saying di two suspects allegedly join other people attack di woman, kpai her and carry her […]

todayAugust 13, 2026 12

Lagos

Police Arrest 38-Year-Old Man Over Alleged Abuse Of 13-Year-Old Stepdaughter

By: Yusuf Abuh Lagos State Police Command don arrest 38-year-old man, Michael, and another suspect over alleged sexual abuse of im 13-year-old stepdaughter for Agege on Sunday, after di girl reportedly suffer repeated abuse. Sources say di girl, wey dey live with di suspect, reportedly dey run away from house before she return to her biological father and tell am say her stepfather allegedly abuse her. Di girl’s father reportedly […]

todayAugust 12, 2026 5

Lagos

Lagos Police Bust Fake Drug Warehouse

Lagos State Police Command say dem don bust two warehouses  wia pipo dey repackage fake drugs, and arrest two suspects. Police Commissioner Fatai Tijani naim package dis mata one on Monday during press tuk, tuk doings inside Violent Crime Response Unit, Ijora Olopa, Lagos. Di two suspects, Eze Okwudilichukwu, 52, and Chukwudi Mba, 42, naim dem catch dem for one warehouse along Otto Causeway, Otto, Lagos, where police say dem […]

todayAugust 4, 2026 10

Lagos

Lagos Police Jam Big Fish! Alleged ₦1 Billion Motor Scam Oga Finally Fall

By : Joalyemi Olajide Di Lagos State Police Command don finally catch di alleged oga of one motor scam syndicate wey police say use magomago way collect 29 vehicles worth over ₦1 billion after e dey dodge arrest for long. Police tok say na confessional statements from arrested gang members and thorough investigation expose di suspect as di alleged brain behind di massive vehicle fraud before officers finally jam am. […]

todayAugust 1, 2026 15

Lagos

Lagos Police Burst one jaguda boys Ama, gbab 150 Suspects

By : Jolayemi Olajide Lagos State Police  command ehn, don do dia normal James Born doings  gbab 150 suspected  jaguda boys, say dem lap di  ama wey dey inside dumpsite for Boolar area near Okofilling Bus Stop, Igando. Na police oga Tijani Fatai naim use im yamchop mouth konfamate this mata for police headquarters  for im monthly tuk, tuk doings. Di senior man Police oga ehn,  konfam oh, say during […]

todayJuly 7, 2026 17

Lagos

Police Shoot Truck Driver For Lagos Checkpoint

By: Yusuf Abuh One truck driver, Peter Francis, dey hospital dey fight to save im leg afta police shoot am over ₦500 bribe for checkpoint along Ketu-Epe-Ikorodu Road for Lagos. Im lawyer, Olatunji Ajayi, talk say Francis obey di police when dem stop am, but e tell di officer say e no get cash again because e don use im last money buy food. Lagos State Police PRO, Abimbola Adebisi, […]

todayJune 22, 2026 17

Lagos

Police Explain Wetin kpai DCP Khan Salihu

Lagos State Police Command don clear air say story wey bin dey fly say late DCP Khan Salihu dem kidnap before im kpai na fat lie from di pit of hell. Police tuk tuk, SP Abimbola Adebisi, explain for statement, say di officer just complain say e no dey well, dem rush am go hospital, naim doctor konfam say e don kpai. Police tuk say di report na fake news […]

todayJune 17, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds