LAWMA

16 Results / Page 1 of 2

Background

Lagos

LAWMA Tell Lagos People: No Buy for Roadside

By: Kofoworola Olayinka LAWMA don warn Lagos residents say anybody wey buy goods from illegal roadside traders fit face arrest and prosecution, as enforcement go start next week. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, give di warning on Tuesday for di authority headquarters for Lagos, saying di move na to stop illegal trading, waste dumping and blockage of public spaces. E say residents wey buy from traders for roads, medians, […]

todaySeptember 9, 2026 7

Lagos

LAWMA Place Beta Seal On Top Some Markets Inside Ajah-Lekki

By: Mariam Ajayi LAWMA don start to dey clamp down for Ajah-Lekki side, as dem don seal some markets, companies and churches wey dem talk say dem no dey follow waste and environmental rules. LAWMA Director of Public Affairs, Mukaila Sanusi, say places like Kodak Moment, Bayrock Lifestyle, Alpha Pharmacy and Ramayaa Mall na among the places wey LAWMA don clamp down on. Di agency tuk say hotels, hospitals, shops […]

todayAugust 31, 2026 8

Lagos

LAWMA Lock Markets Over Dirty Environment

By: Yusuf Abuh LAWMA don lock some markets and plazas for Ayobo, Lagos, on Sunday over repeated environmental violations and illegal dumping. LAWMA Project WISE team carry out di enforcement around Ayobo-Ipaja axis to clear waste backlog and stop illegal dumping. LAWMA boss Muyiwa Gbadegesin say dem target facilities wey repeatedly break di environmental rules despite several warnings. Rock of Age Plaza, Ajerogun I Market, Ayobo Market and Oba Plaza […]

todayAugust 25, 2026 12

Lagos

LAWMA Boost Waste Evacuation As Olusosun Road Improve

By: Olabisi Olatunji Lagos residents fit soon enjoy cleaner streets as LAWMA improve waste evacuation after rehabilitating di access road to Olusosun Disposal Facility. LAWMA say e clear over 18,660 metric tonnes of waste across disposal sites within one week. Managing Director Dr Muyiwa Gbadegesin tok on Wednesday say di agency record 1,866 truck trips between July 28 and August 3, 2026. According to am, di road upgrade don increase […]

todayAugust 5, 2026 9

Lagos

LAWMA Don Lock Shop! Dirty Business Owners For Lagos Don Enter One Chance

By: Esther Daniel No be small Kasala for Ikotun, Igando and Alimosho as LAWMA storm di area on Saturday say hand touch some  market pipo dia, na so dem lock shops and businesses wetin nor good sake of say dem nor clean dia stores environment. All wetin di environment pipo dey tell dem, e be like say dem deaf. Di enforcement team from LAWMA Project WISE West enter area lock […]

todayAugust 3, 2026 12

Lagos

LAWMA Lock Shops For Ojuelegba Over Illegal Refuse Dumping

By: Yusuf Abuh Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don cut chain oh, like dis now hand don touch some shops and business places for Tejuosho-Ojuelegba area because say traders dey dump dirty anyhow. Dis one hapun on Thursday after several warnings and repeated failure by di affected traders to obey sanitation rules. LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, say di action na to restore clean environment, protect public health and make […]

todayJuly 31, 2026 10

Lagos

Lagos Gornment Open New Olusosun Road For Waste Management

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don commission di new 1.2-kilometre access road inside Ojota, to make waste management easier across di state. According to report dis new road go make possible for betaliocious waste management inside di obodo Nigeria. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, naim sorosoke dis mata as im ma go inspect di road. Oga Gbadegesin sef con say dis road go make waste movement smooth for […]

todayJuly 29, 2026 15

Lagos

Bad Smell, dirty Trouble Oshodi As Residents beg gornment for  Action

By : Jolayemi Olajide Residents, traders and commuters for Oshodi, Lagos, don raise alarm say dirty dey smell dem for di area despite baba Govo, Babajide Sanwo-Olu order to increase waste evacuation across di state. New tatafos reach di  Oshodi Bus Terminal area, show plenty dirty dey cover roadside, walkway and part of the road, with bad smell wey dey smell everybodi Some traders complain say di waste don stay […]

todayJuly 15, 2026 12

Lagos

Lagos Court Sentence 16 Offenders To Jail

By: Yusuf Abuh Lagos wast management pipo  don secure court conviction for 16 environmental offenders wey dem arrest for illegal waste dumping across Lagos. According to reports, Di  offenders appear before Oshodi Special Offences and Mobile Court and each receive four months jail sentence for offences including dumping waste for wrong places and refusing to use approved waste collectors. LAWMA  tuk, tuk, Mukaila Sanusi, konfam, say dem arrest di people […]

todayJuly 13, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds