Malaysia Go Ban Social Media Use For People Wey Never Reach 16 From Next Year
Malaysia don plan to ban anybody wey never reach 16 from opening social media account from next year, as di kontri join other nations wey dey introduce age-limit to protect children from online wahala. Communications Minister Fahmi Fadzil talk dis one on Sunday, and im say government dey study how Australia and other kontries take do dia own regulation. Im yarn say cyberbullying, financial scam and sexual exploitation of minors […]