FA Cup Quarter-Final, Man City To Face Liverpool, Port Vale Go Play Chelsea
By: Esther Ayoola England don finish quarter finals draws for FA cup, dat Manchester City go jam Liverpool for FA Cup quarter-finals. According to BBC Sport, Port Vale, wey dey League One, go travel go Chelsea afta dem comot Sunderland. Arsenal go waka go Southampton, wey dey Championship, while Leeds go face West Ham. All di matches, dem go play am for April.