OBODO NAIJA

Ironsi Family Burst Out, Tell FG Say Dem Still Owe Dem Apology And Compensation

todayJuly 31, 2026 8

Background
share close

By: Esther Daniel

Wahala don reopen as family of Nigeria first military Head of State, General Aguiyi Ironsi, don face Federal Gornment, demand apology and compensation over di killing of dia son.

Di family head, Imo Aguiyi-Ironsi, yarn on Thursday for sidun tuk say Ironsi na correct leader wey get vision for Nigeria, but dem cut him journey short after just six months for office.

Imo talk say Ironsi no get hand for di coup wey happen before he become Head of State, say di only thing he do na answer di call to serve him fatherland before dem brutally take him life.

Di family say gornment never truly apologise for di tragedy, as dem dey push for justice, recognition and compensation over di death of one of Nigeria’s former leaders.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds