Oluremi Tinubu

6 Results / Page 1 of 1

Background

National

First Lady Oluremi Address Di Ozoro Festival Isuues

By: Esther Ayoola Wife of Oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don condemn di way Jaguda boys take abuse some women and girls during di Alue-Do cultural festival for Ozoro, Isoko North LGA, Delta State on Sunday. She put for statement, say di viral video show di girls suffer barbaric and degrading treatment for wetin suppose be normal community celebration. Senator Oluremi hail di police wey don make some arrests and […]

todayMarch 23, 2026 6

National

First Lady Oluremi Tinubu Put Call Say Make Mehn Dey Support Women

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, say make everybodi continue to support di rights, opportunities and empowerment of women and girls for di country. As Naija join di rest of di world celebrate International Women’s Day 2026, she tuk say di progress of women dey very importankpa for national development. She also praise di strength, courage and achievements of women, come remind Nigerians say everybody get responsibility […]

todayMarch 9, 2026 3

National

Oluremi Tinubu Bag “Light of God” Title for Warri, Call For Unity

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Oluremi Tinubu, don receive traditional title of Utukpa-Oritse (Ugbone) for Warri Kingdom as dem honour am for her public service and humanitarian work. Di ceremony hapun for her maternal home, Warri, Delta State, where di monarch, Ogiame Atuwatse III, welcome am and praise her effort for women empowerment and social welfare. For her speech, Mama Oluremi, say make Nigerians dey united and live as […]

todayFebruary 27, 2026 4

National

Oluremi Tinubu Explain How Naija Register 14 Childrensis In Two Years

By: Esther Ayoola First Lady of di federal republic of Naija, Oluremi Tinubu, don hail doings of Naija hospital say dem registration of 14 million new born babies She yarn  dis mata on Monday via her X handle afta she receive UNICEF Country Representative  Wafaa Abdelatef and her team wey brief her on birth registration progress last Friday. Senator oluremi describe di movement as major achievement to protect pikins identity […]

todayFebruary 23, 2026 7

National

OAU First Ladies Hail Oluremi Tinubu For Girl-Child Support

By: Esther Ayoola Naija First lady, Oluremi Tinubu don receive honour from Organization of African First Ladies for Development say, she ma try for girl-child education, hygiene, and health for mothers and childrensis for Naija. Dem give am di recognition for di 29th and 30th General Assembly for Addis Ababa, where dem also praise her effort to reduce mama and pikin death rate. In her acceptance, Di First Lady wey […]

todayFebruary 16, 2026 3

National

Remi Tinubu Beg Nigerians To Joinbodi Build United Naija

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Senator Oluremi Tinubu, Once again dey beg Nigerians to join bodi together build di country call Naija, say na only unity go hellep move di country forward. Mama Tinubu yarn dis one on Thursday for Leadership Annual Conference and Award 2025 wey happen for Abuja. Senator Oluremi say, e dey importakpa for pipo to forget religion and region scata scata, and dat na only […]

todayFebruary 13, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app