FG Set Passport Exercise For Nigerians Wey Dey UK
By: Kofoworola Olayinka Federal Gorment don announce dates and places for special passport exercise for Nigerians wey dey live for United Kingdom. Nigeria Immigration Service go carry out di exercise for London, Manchester, Aberdeen and Cardiff. Di move follow directive from Interior Minister, Olubunmi Tunji-Ojo, plus discussion with Nigerian High Commission and Nigerian communities for UK. Di Nigeria Immigration Service say dem deploy Passport Intervention Team from dia headquarters for […]