Lagos Police Commissioner Drop Security Alert
By: Esther Ayoola Lagos Police commissioner Olohundare Jimoh don shake table oh, say make Lagos resident dey always dey alert of security. Jimoh dey yarn dis one give tori pipo as im dey mark one year for inside office. Giving his report card , Jimoh say, just one year im don spend for office, dem don recover over 150 vehicle from jaguda boys, gingering resident to dey at alert always.