President Bola Tinubu

12 Results / Page 1 of 2

Background

National

President Tinubu Make History To Do State Visit For UK After 37 Years

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu and Iyawo, Oluremi  go buy waka do two-day state visit to United Kingdom from March 18 to 19, 2026. Say na King Charles III invite dem officially and according to British royal family tuk tuk dem, say King Charles and Queen Camilla go host Tinubu and im wife, Oluremi Tinubu, for Windsor Castle. Dem announce di visit for dia official X page […]

todayFebruary 9, 2026 4

National

President Tinubu Meet Kwara Govo To Touch Light Di Deadly Worro Attack

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don go do meeting with Kwara State Govo, AbdulRahman AbdulRazaq, for State House Abuja on Thursday, say make im con explain  wetin  hapun for Worro community inside Kaiama Local Government Area. U sabi say, just days ago news report say jaguda boys enter woro community kpai over 160 people, wey gornment link to suspected jihadist fighters. Afta, Govo Abdulrazaq explain to oga […]

todayFebruary 6, 2026 5 1

National

President Tinubu Hail Fela, Afrobeat Legend

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu, don sukilli mouth untop marras dat, Afrobeat oga, Fela Anikulapo Kuti na senior man ni be, and dat im music pass music, afta e win Grammy Lifetime Achievement Award even afta death. Inside statement wey im personally signed, Oga Jagaban describe Fela as fearless, freedom fighter, and revolutionary wey dey fight injustice through im music. Presido say Fela courage, creativity, and conviction […]

todayFebruary 2, 2026 8

National

President Tinubu Approve New Ambassadors, Send Oke Go France, Are Go US, Dalhatu Go UK

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu, don approve di posting of four ambassador-designates out of di 68 wey Senate confirm last year. According to statement from Special Adviser Bayo Onanuga, Ambassador Ayodele Oke go run marras with France and Colonel Lateef A-re go be United States America. President also name Ambassador Amin Dalhatu as High Commissioner to United Kingdom. Tinubu don even direct Ministry of Foreign Affairs make dem […]

todayJanuary 23, 2026 6

National

Kano Governor Abba Yusuf Enter Meeting With Oga Presido, Tinubu

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf, don go put bodi for meeting with President Bola Tinubu for Aso Rock, tuk plenty, even though say, wetin dem tuk, dem never share for public. According to report, di govo enter di President office around 4:13 in di afternoon and comot about three hours later, but e no tuk anything to Aproko pipo wey dey gate. But from di little informate […]

todayJanuary 20, 2026 9

National

Tinubu Order Tell Security To Act Fast On Kano Woman, 6 Pikins Wey Kpai For Kano State

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don order full investigation into di killing of housewife Fatima Abubakar and her six pikin for Chiranci community, Kano State, on Monday. Im Special Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk say di President belle nor sweet am at all for di mata, call am barbaric. Tinubu Sha praise police for di quick arrest of di main suspects. Him don direct […]

todayJanuary 19, 2026 5

National

President Tinubu Fix South East Roads After Years Of Abandonment

By: Esther Ayoola Minister of Works, David Umahi, say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu handiwork dey show small small for South East Nigeria afta many years of abandoned project. Umahi tuk dis one for weekend afta e inspect several federal road and bridge projects across di South East and South South regions. E say di Tinubu administration dey serious with infrastructure development and determined to complete all important road […]

todayJanuary 19, 2026 5

National

President Tinubu Hail Baba Bisi Akande at 87, Call Am Pillar of Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu like dis, dey cut cap for senior govo, di b4, b4 govo Osun State  and APC pioneer chairmo, Chief Bisi Akande, as e clock 87 years of age. Tinubu describe am as mentor, ally and strong pillar wey hellep build and sustain democracy for Naija. According to Oga Presido, Baba Akande follow Obafemi Awolowo political ideology and later leave im accountant work […]

todayJanuary 16, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app