FG Reduce Textbook Assessment and Ranking Fee
By: Esther Daniel Federal Goment don reduce money wey publishers and authors go pay to assess and rank textbooks, as dem dey prepare to start di National Textbook Ranking System. NERDC Executive Secretary, Salisu Shehu, tok dis one for statement wey dem release on Wednesday for Abuja, say assessment fee don drop from ₦2,000 to ₦1,500 per page, while ranking fee reduce from ₦1 million to ₦750,000 for each textbook. […]