Kebbi Govo Extend Retirement Age For Doctors, Medical Workers
By: Esther Ayoola Kebbi State Governor Nasir Idris don approve new retirement age for medical and veterinary doctors, as dem now go retire for age 65, instead of di nromal 60. Di decision hapun during Kebbi State Executive Council meeting wey dem hold on Monday for Government House, Birnin Kebbi. Commissioner for Establishment, Pension and Training, Auwal Dogondaji, naim make dis announcement while e dey brief journalists afta di meeting. […]