National

Kebbi Govo Extend Retirement Age For Doctors, Medical Workers

todayJune 9, 2026 2 1

Background
share close

By: Esther Ayoola

Kebbi State Governor Nasir Idris don approve new retirement age for medical and veterinary doctors, as dem now go retire for age 65, instead of di nromal 60.

Di decision hapun during Kebbi State Executive Council meeting wey dem hold on Monday for Government House, Birnin Kebbi.

Commissioner for Establishment, Pension and Training, Auwal Dogondaji, naim make dis announcement while e dey brief journalists afta di meeting.

According to gornment, di new policy go affect doctors and veterinary professionals for Kebbi State Civil Service by allowing dem serve longer before retirement.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds