Sports

9 Results / Page 1 of 1

Background

Sports

Lookman Eye Champions League Semi-final As Atletico Madrid Battle Barcelona

Ademola Lookman dey prepare body to become di only Nigerian wey go reach UEFA Champions League semi-final dis season as Atlético Madrid dey host FC Barcelona for dia important second leg quarter-final today. Atlético get two-goal advantage after dem win di first leg for Camp Nou. For Nigerian fans, all eyes dey on Lookman wey don score 5 goals and give 3 assists in 16 appearances since e join Atlético […]

todayApril 14, 2026 2

Sports

Inter Milan Extend Dia Lead For Seria A Beating Roma 5-2

Inter Milan  knack Roma 5-2 for Serie A inside San Siro on Sunday, to take dia lead to nine points ahead of AC Milan. Lautaro Martinez come back from injury, score two goals, while Marcus Thuram score im first goal since February. Hakan Calhanoglu score beta shot before half-time and Nicolo Barella add another one, making it a sure win.

todayApril 6, 2026 5

Sports

Chukwuma Beat Ofili, Win First Outdoor Doings For Louisiana

Nigerian sprinter Rosemary Chukwuma don start her outdoor season with beta result, wining di Battle for Bayou matas wey hapun for Louisiana. She run 10.81 seconds (+3.1 m/s) to beat her training partner Favour Ofili and Canada’s Audrey Leduc, wey finish together for 10.93 seconds. Chukwuma pick race for di blocks, sharp-sharp and hold her lead till di finish, even as Ofili try rush at di end. Dis timing sef […]

todayApril 6, 2026 3

Sports

Sabalenka Knock Coco, Carry Sunshine Double for Miami

Aryna Sabalenka don win her second Miami Open title straight, she beat Coco Gauff 6-2, 4-6, 6-3 to finish di “Sunshine Double” for Indian Wells and Miami. Sabalenka, wey be world number one from Belarus, don join Iga Swiatek, Steffi Graf, Kim Clijsters, and Victoria Azarenka for di list of women wey don win both early-season WTA 1000 title for same year. According to Sabelenka, her aim na to put […]

todayMarch 29, 2026 8

Sports

LOC Shift NYG Closing Ceremony Date to Cut Cost

The Local Organising Committee (LOC) wey dey run the ongoing ninth National Youth Games (NYG) for Asaba don assure say the Games closing ceremony no go clash with Super Eagles World Cup qualifier match against Rwanda wey dey Saturday. Originally, dem plan to hold the closing ceremony on Sunday, September 7, but dem don shift am go Saturday, September 6. Festus Ohwojero, one member of LOC, talk say if dem […]

todaySeptember 4, 2025 21

Sports

NPFL: Ogenyi Hail Pillars, Talk Why Musa Play Full 90 Minutes

Kano Pillars head coach Evans Ogenyi don praise him players for the way dem take fight, even though dem lose 1-0 to Abia Warriors for their Nigeria Premier Football League opener for Umuahia. Ogenyi admit say the result no sweet, but e talk say the team show some better signs. “The team dey blend well, and make you remember say no team perfect anywhere for the world. We don see […]

todayAugust 25, 2025 37 2

Sports

Super Eagles Hammer Côte d’Ivoire 3–0 as Dem Begin Title Defence

Super Eagles don begin dia title defence for di 13th West Africa Deaf Football Tournament with serious fire, as dem knack Côte d’Ivoire 3–0 for inside Moshood Abiola National Stadium, Abuja, on Thursday. Even though first half end goalless, second half na different story as naija boys wake up and fire three correct goals wey leave di Ivorians confused. Di win na bold statement say Nigeria no come play, dem […]

todayAugust 22, 2025 25 5

Sports

NPFL 26: Ilorin Stadium Go Host Niger Tornadoes vs Nasarawa United Clash

Niger Tornadoes first match for di 2025/2026 NPFL season no go happen for their home ground again. Di game wey dem suppose play against Nasarawa United don shift go Ilorin Township Stadium. Di match go now hold on Wednesday, 27th of August, 2025. Wetin cause di change? NPFL talk say di stadium for Minna  Bako Kantagora Stadium  no meet di required standard wey clubs suppose get under the Club Licensing […]

todayAugust 22, 2025 114 9

Mokoena

Sports

2026 WCQ: South Africa Fit Lose Points For Using Player Wey No Suppose Play

Bafana Bafana wey be South Africa team don jam wahala for dia road go 2026 FIFA World Cup sake of yellow card gbege wey concern dia midfielder, Teboho Mokoena. According to wetin majic828.co.za talk, tori dey fly say Mokoena no suppose play for Bafana Bafana matchday 5 game against Lesotho, and e fit affect dia chance to qualify. Mokoena chop yellow card for dia first match wey dem play against […]

todayMarch 25, 2025 752 59

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app