Coach Gamondi Say Tanzania Sabi Ball Pass Nigeria
By: Rilwan Agbomeji Tanzania coach Miguel Gamondi talk say e still dey happy small with how im team play, even though dem lose 2–1 to Nigeria for AFCON match on Tuesday. Na Nigeria score first through Semi Ajayi, before Charles M’mombwa equalise for Tanzania early second half. But celebration no last as Ademola Lookman quickly score winner give super eagles, while Tanzania still dey find dia first AFCON win. […]