By : Jolayemi Olajide
Wi oga Presido President Bola Tinubu don give retired Major General Adeyinka Famadewa new position say make e work as Special Adviser on Homeland Security.
Say dis na di first time Nigeria dey create dis kain position for federal level.
Dem drop the announcement on Monday through office of SGF George Akume.
Gornment talk say the new office go help security pipo to reason together, share beta intel, and tackle all di security gbege wey dey happen for different sides of the country.