By: Esther Ayoola
Wi oga Presido Bola Tinubu tuk say di economic reforms wey im gornment bring don start to show beta result, as di country macro-economy dey stabilize small small and money wey federal dey share to states and local governments don increase.
Im yarn dis one on Monday for Abuja, as e open di two-day National Economic Council conference.
According to Di presido, sai Naija dey face plenty wahala like economic imbalance, bad infrastructure, unemployment, poverty, climate problem and small money to spend, but e say Nigerians strong well well and our creativity sti be one big advantage for di country.