By: Esther Ayoola
President Donald Trump top counterterrorism senior man, Joe Kent, don resign over di war wey dey hapun for Iran.
For im letter for X, e tuk say Iran no get “imminent threat” for US and so im nor understand di kind of war dem dey fight for Iran
Meanwhile, White House say dem get strong proof say Iran bin dey plan attack US first.
With im resignation, Kent na di most senior person wey don openly criticize di US-Israeli attack on Iran.