obodo oyinbo

Ukraine and Russia Don Resume War As One Don Kpai

todayMay 12, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Russo-Ukrainian War don start again as Russia resume drone strikes on Ukraine after a short three-day truce expire on Tuesday.

Ukrainian authorities say one person sef don kpai for Dnipropetrovsk region during di renewed attacks, while Kyiv also come under fresh drone threat, with military officials warning residents to stay indoors until air raid alert clear.
Di head of Kyiv military administration, Tymur Tkachenko, announce say enemy drones dey over di capital again, marking di first confirmed alert since di ceasefire start on Friday.

On di other side, Russian military claim say dem shoot down about 27 Ukrainian drones after di truce end.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds