By: Esther Ayoola
Head of Ukraine patrol police, Yevhen Zhukov, don resign afta two of im officers face serious criticism say dem run comot during deadly shooting for Kyiv.
Di attack hapun on Saturday for Holosiivskyi area, wia one-man open fire for street, kill 6 people and injure 14 others before e take some people hostage for supermarket.
Police later engage am for gun battle and dem kpai di attacker.
Ukraine Interior Minister, Igor Klymenko, tuk say dem don suspend di officers and investigation don start on top wetin dem do.