Lagos

UNILAG And UK University Join Bodi Set Up New School Unit For Obodo Nigeria

todayJanuary 30, 2026

Background
share close

By: Esther Ayoola

University of Lagos (UNILAG) and University of Birmingham for UK don sign Memorandum of Understanding to set up Transnational Education Unit, inside, UNILAG.

Dis agreement go make dem work with Nigeria Ministry of Education to prepare plans, with aim to start teaching students by 2027.

According to report, di courses go include Applied Intelligence, Digital Communication and Media, health sciences and engineering.

Education Minister, Dr Tunji Alausa, wey wet di ground for our UK brodas, sha explain dat, di reason for di partnership, na to hellep produce graduates wey fit compete anywhere for di world.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app