Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
US Defense Secretary, Pete Hegseth, don announce on Thursday say dem dey carry out new military operation wey dem call “Operation SOUTHERN SPEAR” to “remove narco-terrorists,” as worry dey grow say US naval buildup for Latin American waters fit mean say dem fit do land strikes and start bigger wahala. Hegseth yan for X say, “Dis mission dey defend our Homeland, remove narco-terrorists from our Hemisphere, and secure our Homeland from di drugs wey dey kill our people.” Dem no give any detail about how di operation go take run or how e go different from other military actions wey dem don dey do before.
Di Trump administration don dey run military campaign for Caribbean and eastern Pacific, dey deploy naval and air forces as part of anti-drugs fight. US forces don carry out strikes for about 20 vessels for international waters for di region since September, wey don kill at least 76 people, according to US figures. Pentagon spokesperson no give any extra info about di operation, just refer people back to Hegseth post for X. CBS News yarn say top military officers don show Trump updated options wey fit include land strikes for Venezuela. Venezuela don announce major nationwide military deployment to counter US naval presence, wey include new US aircraft carrier strike group, F-35 jets for Puerto Rico, and six US Navy ships for Caribbean. Dem dey fear say US dey plan regime change.
Written by: News Editor 1
Latin America conflict narco-terrorism update US anti-drug mission US army Latin America US military operation Latin America
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025