By: Esther Ayoola
Di US Food and Drug Administration don open one mata dey touchlight deaths of US citizens, wey some people claim fit relate to Covid-19 vaccines.
According to report, Since Presido Donald Trump appoint Health Secretary Robert F. Kennedy, US gorment big overhaul of vaccine policy, and dis move don raise worry among medical experts.
Kennedy tuk tuk persin Andrew Nixon tell tori pipo say, FDA dey run thorough checks across different age groups to confirm wetin truly dey happen.
Di matter heat up afta one internal document leak for late November, even as authorities never talk say di vaccines cause di deaths.