By: Esther Ayoola
United States gonment don announce new travel rules dis week, wey fit make Nigerians wey dey apply for B1/B2 visa pay bond of up to $15,000.
According to US Department of State website, Travel State.Gov, even if applicant pay di bond, e no guarantee say dem go issue visa.
Dem also warn say any fee wey person pay without direction, say consular officer no go fit return di money.
Di updated list show say 24 of 38 countries wey dis rule affect na African countries, and Nigeria dey among dem.