By: Esther Ayoola
Na historic weekend for Naija football, as Victor Osimhen score im 200th career goal on Sunday helping im club to collobi betterlicious 4 kondo victory over Kayserispor.
Di Galatasaray striker score di second goal as dem beat Kayserispor for Turkish Super Lig.
So far, Osimhen don play 336 games, score 200 goals, and give 51 assists for club and country.
And majority of di goals come for di time wey play for Napoli and Galatasaray, solidifying him as one of Africa best forwards in history.