National

WAEC Release Second CB Result

todayFebruary 17, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

WAEC don release di 2025 Second Series CB-WASSCE results for private candidates,

According to a statement by Acting Head of Public Affairs, Moyosola Adesina,  on Monday for Lagos, say  Candidates fit check dia results online for www.waecdirect.org before dem fit collect digital certificate for www.waec.org.

To get hard copy certificate, candidates suppose apply online through WAEC e-Certman portal at https://certrequest.waec.ng/, as WAEC advise make dem act quick.

Say na Total of 65,752 candidates sit for di exam for 370 centres across Nigeria, including 235 people wey get special needs like blind, deaf, and albino, so dem fit konfamate dia result one time.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app