Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Oyo State Governor, Seyi Makinde, don yarn why e comot from Wike. Dem two people bin dey close friends and political comrades, and dem work together for 2023 with three oda people to form di famous G5 Governors wey lead di fight to stop di PDP presidential candidate from winning di election. But today, dem don waka different ways, even though dem still dey inside di PDP. Makinde talk say Wike dey push for one-party state, wey no match with di vision of Nigeria founding fathers, and dat na wetin break di ice between dem friendship.
Makinde add say di wahala no be PDP, na about di future of democracy. E talk say, “We suppose sabi say sometimes e go worse before e better. And if we gatz stay here for di next two weeks so that democracy go survive for Nigeria, una go see us here.” On top wetin dey cause wahala between am and Wike, e talk, “Small mind dey talk about people, average mind dey talk about events. We go rather talk about issues. Di issue be say we no believe for one-party Nigeria. We believe say our Founding Fathers give us multi-party democracy.” E con add, “We gatz maintain am so Nigerians go get option when dem dey choose leaders. Dat na di koko, I no wan talk about people, I no wan talk about events.”
Written by: News Editor 1
Makinde Makinde vs Wike political breakup
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025