By: Esther Ayoola
Say, one strong storm sweep across di United States kpai at least 11 people on Monday, as authorities warn residents make dem stay off road because of dangerous weather.
Di storm wey dem dey call dump snow, do wetin nor good and na so freezing rain from Texas reach New England, spoil light and flight cancel across many states.
New York City Mayor, Zohran Mamdani, tuk to reporters say five people kpai over di weekend, warn say extreme cold sti dey come.
For Texas, local authorities confirm three deaths, including one 16-year-old girl wey die during sledding accident.