obodo oyinbo

Xenophobia Kpai 2 Nigerians For South Africa, Diaspora Be FG For Help

todayApril 28, 2026 5

Background
share close

Fresh xenophobic wahala don break out again for South Africa on Monday, dat two Nigerians don go down for di mata.

For statement wey dem wrap like moimoi, na Nigerian Consulate General for Johannesburg, Nigerians, Ninikanwa Okey-Uche, dey konfamate dis mata say, Amaramiro Emmanuel and Ekpenyong Andrew, na im be di two pipo kpai name.

Nigerians wey dey South Africa dey cry for help and dey beg Federal Gornment make dem protect dem, because of rising anti-foreigner attacks.

Consul-General Ninikanwa Okey-Uche explain say Emmanuel kpai on April 20 for Johannesburg after South African National Defence Force personnel allegedly beat am.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds