By: Esther Ayoola
At least, ten pipo don kpai for Gaza, afta Israeli air strikes and fight between Hamas and Israel-backed militia.
According to local hospital source, di fight hapun Monday, near Maghazi refugee camp, when Hamas pipo attack militia wey go do checkpoint for dia area.
Al-Aqsa hospital for Deir al-Balah naim receive di bodies, and many other pipo wunjur, some dey critical condition.
Local witnesses tuk say di clash start because of tension between Hamas and militia, but Israeli army and Hamas never give official comment yet.