Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
At least eight people don land for hospital after one truck jam eight motor for Otedola Bridge wey dey Lagos-Ibadan Expressway on Wednesday night. Di wahala happen just few hours after another truck don kill one keke rider for Ekoro area earlier di same day. According to wetin di Lagos State Police Command Rapid Response Squad talk for dia statement, di truck bin dey go outside Lagos when e jam di motor dem. Dem list di vehicles wey involve for di crash, one truck, two passenger buses, five cars and one minibus.
Di statement talk say more than eight passengers sustain serious injury after di loaded truck ram enter two 18-seater buses, one minibus and five cars. Dem don rush di injured people go Accident and Emergency Centre for Old Toll Gate for treatment. As festive season dey near, accident cases don dey increase across Lagos. Report don show say from January to September 2025, about 87 people don die and 666 don wound for 1,006 road accidents. LASTMA and FRSC don warn motorists make dem no dey drive carelessly, use alcohol or drive for night, as “Ember Months” dey always bring more deadly crashes.
Written by: News Editor 1
FRSC Lagos Lagos traffic crash Otedola Bridge accident
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025