Cristiano Ronaldo don score him 39th goal for World Cup qualifier match, wey make am now joint-highest goal scorer ever for dat tournament level, join body with Guatemala legend Carlos Ruiz, and e still senior Lionel Messi with three goals. Di 40-year-old striker still extend him international goal record to 141 goals in 223 matches for Portugal, na di highest ever by any male footballer for any country.
Ronaldo score di goal on Tuesday for Puskas Arena from penalty spot inside 58th minute, after Hungary player Barnabas Varga first open scoring for 21st minute. Manchester City baller Bernardo Silva cancel am 15 minutes later. Varga later equalise again for 84th minute, and e be like say Hungary go manage draw di match. But just two minutes later, Joao Cancelo burst net to give Portugal dramatic 3-2 win for coach Roberto Martinez. Ronaldo sef bin score two goals for Portugal 5-0 win over Armenia on Saturday, and now dem dey sit top of Group F with six points from two matches. Hungary dey third with just one point, join body with Republic of Ireland wey chop 2-1 loss for Armenia.