CRISTIANO RONALDO

10 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Ronaldo Near 1,000 Goals as Im Score 981st Career Goal

Cristiano Ronaldo don score im 981 goal for career as Al-Nassr beat Neftchi Fergana team from Uzbekistan 3-1 for di AFC Champions League Elite match on Monday. Di 41-year-old Portuguese superstar score di second goal for Al-Nassr for di 42nd minute after Angelo Gabriel bin open score for 33rd minute inside Al-Awwal Park stadium for Riyadh. Sadio Mane float one sharp cross from di left, Aiman Yahya use im chest […]

todayOctober 13, 2026 6

Sports

Ronaldo Sister Blast Portugal Say Dem No Deserve Di Best At All

Jolayemi Olajide Cristiano Ronaldo sister, Elma, don come out to cut chain give Portugal after her brother comot from di national team camp on Wednesday. For post wey she make for Instagram, Elma say Portugal no deserve di best for anything. She say CR7 deserve more respect, while di national team need better settings, and Portuguese tori pipo  gas do better instead of spreading rumor. Elma still blast Portuguese pipo, […]

todayOctober 1, 2026 15

Sports

Ronaldo Comot From Portugal Camp, Return Madrid

Cristiano Ronaldo don return Madrid after e announce say e don comot from Portugal national team camp on Wednesday. Football transfer expert, Fabrizio Romano, disclose dis one for im post on X, as Ronaldo land for Madrid around 2 a.m. local time after e officially withdraw from di Portugal squad. Di Al-Nassr striker reportedly decide to leave di camp after e discuss with Pedro Proença, President of Portuguese Football Federation, […]

todayOctober 1, 2026 15

Sports

Ronaldo World Cup Dream Ends

By: Yusuf Abuh Cristiano Ronaldo World Cup journey don end for heartbreak again, after Spain beat Portugal 1-0 for Dallas Stadium on Monday night, thanks to Mikel Merino late goal. Ronaldo, wey plenty people believe say na im last World Cup match be dis, try lead Portugal attack with João Félix and Bruno Fernandes but dem no fit score goal. Spain defence stand gidigba throughout di match, while goalkeeper Unai […]

todayJuly 7, 2026 26 1

Sports

Portugal Beat Super Eagles

Nigeria super eagles fall hand and leg go  lose 2-1 to Portugal for international friendly match. Pedro Neto open naim open di scoring for Portugal before Akor Adams equalise for Super Eagles to make am 1-1. Later, substitute Francisco Conceição bend one fine shot enter net to restore Portugal lead and seal di win. Di result mean Portugal go enter di World Cup with back-to-back victories.

todayJune 11, 2026 20

Sport Yarns

Ronaldo Make History Again As Portugal Release World Cup Squad

By: Esther Ayoola Portugal national football team don confirm dia squad for upcoming FIFA World Cup 2026, with Cristiano Ronaldo set to make record sixth appearance for di competition. Head coach Roberto Martinez tuk say di selection carry emotional weight, especially as dem also honour former international Diogo Jota. Di 41-year-old striker being part of di squad mean say, im na one of di first 3 male player ever to […]

todayMay 20, 2026 28

Sports

Ronaldo Put Bodi For Conner To Protest Lack Of Signing Of AL-Nassr

By: Esther Ayoola Reports say Cristiano Ronaldo no go feature for today league match, even though e dey fully fit. Planet Football report on Monday say di Portuguese star, wey dey play for Al-Nassr for Saudi Arabia, take dis decision for February 2026. Ronaldo, five-time Ballon d’Or winner and one of football greatest players, don get history of showing frustration when things for him club no dey go di way […]

todayFebruary 2, 2026 30

Sports

Mbappé Join Cristiano Plus Two More Real Madrid Legends For Special List

Real Madrid don dey suffer small wahala as e dey happen anytime Kylian Mbappé no fit score. After im start di season well, e jam small dry patch wey coincided wit three game wey dem no fit win. Na so pressure start dey build for team, but Mbappé show up for di big match against Olympiacos. After Real Madrid fall behind for Athens, di French star switch things up gbagam, […]

todayNovember 28, 2025 48

Sports

Burley Drag FIFA Over Ronaldo Red Card

Former Chelsea midfielder, Craig Burley, don drag FIFA after dem allow Portugal captain Cristiano Ronaldo play for im country for 2026 FIFA World Cup opener. Burley talk say di decision na mockery and complete shame as dem suspend di ban and reduce Ronaldo red card to one-game suspension. Recall say Ronaldo bin collect red card for Portugal 2-0 loss to Ireland after im elbow Dara O’Shea off di ball. Di […]

todayNovember 26, 2025 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds